you have the possibility to publish an article related to the theme of this page, and / or to this region:
Nigeria - -An information and promotions platform.
Links the content with your website for free.
Nigeria - Web content about Unilorin student beats lecturer
Di school authorities don find Salaudeen Waliu Aanuoluwa, wey dey Department of Microbiology, guilty for beating female lecturer wey dey for im department.
Inside statement wey di University Director of Corporate Affairs, Mr.
Kunle Akogun give, e say di school make decision to expel Salaudeen after di Student Disciplinary Committee tok wit am.
Di committee give am 48 days to appeal to di Vice-Chancellor in case im feel dissatisfied wit di decision.
According to di statement, inside letter wey di University Registrar write give Salaudeen e say, 'You go remember say you appear before di Student Disciplinary Committee (SDC) to defend yourself concerning di allegation of misconduct against you.
' After due consideration of all evidences before am, di Committee dey convinced beyond any reasonable doubts say e get allegation of misconduct against you.
' Accordingly, e don recommend to di Vice-Chancellor, who exercise di power wey im get, direct say make dem expel you Salaudeen Waliu Aanuoluwa from the University.
Di school ask Salaudeen to submit every property wey belong to di school to including im ID card to di Dean of Student Affairs and make im no near di campus again.
For inside statement wey di school Vice Chancellor Dr.
Fola Olowoleni bin first sign wen di incident first happun, di school confam say di incident happun on Thursday, 11 November.
Di 400 level male student of di Department of Microbiology assault one female lecturer, identified as Mrs.
Zakariyyah for di same department.
Di university say di security personnel dem don take Salaudeen Wasiu Aanuoluwa into di custody for questioning and im go later appear before di Student Disciplinary Committee.
Di Academic Staff Union of Universities (ASUU), University of Ilorin (Unilorin) Chapter, don also condemn di attack on di female lecturer by di student.
Prof.
Moyosore Ajao, di Chairman of di association follow tok for Ilorin on Monday say dem no go allow di act go unaddressed.
'No be just because di lecturer na female but because she be human being and violence no dey tolerated for ASUU, more or less for one university wey a character and learning be di essence of it.
' But I fit tell una say di Union no dey sleep on di mata and we no go allow dat kain mata to go under di carpet,' im tok.
From wetin we gather from di school authority, di tori be say di student allegedly attack di lecturer for inside her office.
Claims dey say na because di lecturer refuse to help am over im failure to do di mandatory Students Industrial Work Experience Scheme.
School authority say di lecturer don dey recover after di ugly incident happun wey make dem rush her go hospital.
Di papa of Waliyu Anuoluwa po Salawudeen wey im nickname be Captain Walz say im no sabi wia all dis wahala dey come from wey im pikin go beat lecturer.
For one interview wey im do wit BBC Yoruba, Im tok say Waliyu younger brother bin first call di family attention to one incident wey happun on Wednesday, a day before im attack im lecturer.
'On Thursday wen I reach Ilorin, I call im brother, na im tell me say Waliyu don go beat im lecturer.
'